Skip to main content

Chief of Army Staff Attahiru Ibrahim burial: Funeral for COAS and six senior officers wey die for plane crash as e dey hapun

 BBC News, Pidgin

Chief of Army Staff Attahiru Ibrahim burial: Funeral for COAS and six senior officers wey die for plane crash as e dey hapun

File foto of di late General Attahiru Ibrahim

WIA DIS FOTO COME FROM,NIGERIA PRESIDENCY

Wetin we call dis foto,

Di late Lt Gen Attahiru

Dem go lay di remains of Nigeria late Chief of Army Staff Lt Gen Ibrahim Attahiru to rest on Saturday.

Lt Gen Attahiru die for military plane crash, togeda with 10 oda officers including di crew on dia way to Kaduna from Abuja, on Friday, 21, May, 2021.

Di burial proceedings of di late Attahiru and 6 oda senior officers wey lost dia lives inside di air crash for Kaduna happun on Saturday, 22 May 21 in accordance wit Muslim rites.

Chief of Army Staff wife arrive for burial of her late husband
Wetin we call dis foto,

Wife of di late Chief of Army Staff (in black) arrive di Grand Central Mosque for Abuja, for wia di burial service for her late husband go happun.

Di burial proceedings take place for di National Mosque and National Christian Centre, for di kontri federal capital territory Abuja.

Afta dat one, di burial go take place at di National Military Cemetery, Abuja same day.

Di remains of di COAS arrive Abuja central mosque
Wetin we call dis foto,

Di remains of di COAS arrive Abuja Central Mosque

Wetin we call dis foto,

Dem don ready di graves wia dem go bury di late Chief of Army Staff and di oda officers wey die inside di plane crash wey happun for Kaduna on Friday.

Wetin we call dis foto,

Family members mourn di death of Army officer

Wetin we call dis foto,

Di Army also bury six oda officers wey bin dey di COAS entourage to Kaduna

Oda military officers wey follow die for di military plane crash include:

  • Brig-Gen Mohammed Idris Abdulkadir
  • Brig-Gen Olatunji Lukman Olayinka
  • Brig-Gen Abdulrahman Kuliya
  • Maj Lawal Aliyu Hayat
  • Maj Nura Hamza
  • Sgt Umar

Crew members include:

  • Flt-Lt TO Asaniyi
  • Flt-Lt AA Olufade
  • Sgt Adesina
  • Acm Oyedepo

Another thing we de for inside dis tori

Comments

Popular posts from this blog

VALIVE24 WORLDPRESS COM

  Gospel lyrics international spon.